Atiku Say Tinubu Need to Declare State of Emergency on Top Im Own Presidency and Government, No Be on Any Region


 

Former Vice President Atiku Abubakar don para on top President Tinubu leaderhip, e say President Tinubu suppose declare state of emergency on top im own presidency, no be on any region for Nigeria. E say Nigeria don enter full state of emergency already, because of wahala wey dey worry the whole entire country.

Atiku talk say Tinubu dey do like say nothing dey happen, even though insecurity dey worsen, economy dey hard, and plenty other problems dey ground. E say Tinubu dey travel go France dey chop life, Dey go Retreat while Nigerians dey here dey suffer and die every day.

E mention say Tinubu go France on April 2, 2025, and say if dem announce am one day before, people for think say na April Fool joke. E say na insult to Nigerians wey Tinubu dey treat like fool.

Atiku dey para say Tinubu dey prioritize overseas trip over the lives of Nigerians. E talk say people dey die for Plateau and Benue because of violence, Boko Haram don dey strong again, and poverty dey increase.

E say Tinubu dey spend money wey e borrow on top unnecessary foreign trips, say e no dey responsible at all, e dey even show say e no care about Nigerians well being . E talk say Tinubu don spend 59 days for France since e enter office, say e suppose use that time solve the problems for Nigeria.

Atiku say Tinubu no get empathy, say e suppose cut im trip short and come back home. E say good leader no need people to beg am before e show up when wahala dey.

E come add say, Tinubu dey declare political emergency for Rivers for im own political gain, but the real state emergency dey cover the whole country as the everywhere don collapse. E con ask say, na when Tinubu go declare state of emergency on top im own Presidency /Government wey dey fail?

Tags

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.

#buttons=(Ok, Go it!) #days=(1)

Our website uses cookies to enhance your experience. Learn More
Ok, Go it!