Big Lie! Rivers State Sole Admin Dor Deny Say he Summoned Fubara and Deputy to Govt House


 Rivers State Sole Administration Dor deny say he summoned Fubara and his Deputy to Government House o.The oga wey dey run things now, Ibok-ete Ibas, don talk say all the news wey dey fly for social media say dem summoned the suspended Governor, Siminalayi Fubara, and his deputy, Prof. Ngozi Nma Odu, make dem come Government House for meeting, na big lie.

Dem say some paper dey go round say dem tell Fubara make e show face on Friday, April 18, 2025, to come explain all the people wey he put for office when he dey power. The paper even say dem want make he bring paper to show why he do wetin he do and why he want his job back.

But the Rivers State Government don come out straight to say dat news na scam, e no be true at all.

The government yarn say some people dey cook up lies like dis to confuse people, make dem dey fear, and spoil the peace for Rivers State.

Dem make am clear say dem no send any invitation like dat to anybody and dem warn everybody make dem no listen to dat kind fake news.

The Permanent Secretary of the Special Services Bureau, Sir Dede Sampson Friday, sign the paper wey talk say make people dey shine their eyes and only believe news wey come from the government official channels.

Tags

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.

#buttons=(Ok, Go it!) #days=(1)

Our website uses cookies to enhance your experience. Learn More
Ok, Go it!