Presidency Don Come out Defend The 10 Billion Naira Solar Power Project for Aso Rock


Presidency people don come out yarn about dat 10 billion naira dem wan use do solar power for inside Aso Rock. Plenty people been dey vex say why dem go spend dat kind money now now wey things hard for Naija.


But the Oga President mouth-piece, Bayo Onanuga, say no be anyhow thing o! He say make Aso Rock use sun power na good thing wey other big countries dey do too. He even point hand to America White House say dem sef dey use solar.


He show video too, wey show how America do their own solar project for their president place. He say the reason dem do am be say na better way to get light and e no dey spoil environment.


The 10 billion naira project go give steady light for President house, office, and other important places inside State House. Dem say e go help save money for long run and make things better for environment.


Some Naija people say the solar thing good for environment, but some dey vex say the money too much, especially when many people dey suffer. Dem say dem for use the money do other things wey go help people quick quick.


For naija, The welfare and security of the d people wey dey government dey always dey come first before the citizens own. 


Even when millions of Nigerians nor get lights,nor dey see lights take run their business. ,The government dey fully prepared and ready to use 10 billion and even more to give just one man and him family light 

Tags

Post a Comment

0 Comments
* Please Don't Spam Here. All the Comments are Reviewed by Admin.

#buttons=(Ok, Go it!) #days=(1)

Our website uses cookies to enhance your experience. Learn More
Ok, Go it!